Oga president, First of all I hail ooo! I no say u no dey cary last. You be confirm
warri pikin. But ur middle name Ebele means mercy and make u pity ur
children settle their lecturers naa! The matter neva tire u? Suppose say
ur pikin wey u born for belle follow us dey house, Sheeh you for never
answer our we lecturers them? Una say make we bone kidnapping, militant
things and all the bad bad things go enter school, now now na una com
dey f**k up.
All the things wey them lecturers don teash us for klass we don
forget am finish. Last last, na una go still call us “half- baked”,
“half-roasted”, abi na “half-fried”. Na una sabi.
Them talk say person no fit run pass him shadow. We go dey lasgidi
dey for you. Na ur time be dis use am well, but we go catch you for
2015. U don forget say youths na we dey vote pass. Na we too dey snatch
ballot box, dey do rally and som kain kukere things them wey them dey
take win election. U go still nid our help. That time too we go go
strike. Shebi u sabi waka for bare feet, u go carry ur leg do ur rally.
No thugs for u. We no go snatch ballot make you for win. If any maga
try am we go fall am. So Oga Jona, na ur opportunity be dis ooo. Make u
code this stubborn ASUU make dem cary their wahala go back. We no say na
rush them go rush us we no send. All join. Na who get leg dey pass exam
no be who read. Na still who get leg dey get beta work. Na Naija we
dey.
So make u do something because our mate dem for private university
don graj finish. We don tire to dey beef them. If u no shake bodi fast
make u no forget say university of militancy still dey admit. Dey neva
release 2nd batch ooo!
May u grit maale Patience for we, thank baba God say she and gran
papa Soyinka don settle that their quarrel, 2 agbayas, plus all those
bad belle advisers wey u get. God pass them! Bros Amaechi still dey
Niger-delta here, the guy don tire for ur mata. We dey grit u for am
too.
We go stop for here. E go be na.
Naija! student for life!
Na ur waffi boy.
Wahala dey o..............this is painful, i feel the letter die :(
ReplyDelete